01/03/2025
HOW GOD CREATED WOMEN
Angel Micheal comes to see God finishing up his work on the female body.
Angel Micheal; "Baba God, you too much, this one is a Master piece.
See shape, see skin, see Yash, see Bress.
You too sabi wahali"
God: "Yes na.. Na why I be Alpha and Omega na...
I no be anybody mate for Inside this business"
Angel Micheal: "Boss!!!! I am very loyal.
Shei you go mold one give me"
God: "My Friend are you normal, woman na for man no be for Angel.
Abi you get money to dey buy sharwama??
Common go bring water come, make I complete this work.
Wetin dey worry you?"
Angel Micheal brings water....
God: "Oya for caring.... Pour small water"
Angel Michael pours...
God: "No.. E no reach.... pour again put so that she go fit take care of family... Shei you grab!!!"
Angel Micheal pours more water.
God: "Oya, for cravings... Pour ten litres"
Angel Micheal: "Aha..... boss ten litres no too much??"
God: "My friend pour this thing, we need do make she dey ginger man make I'm go hustle.
Shei you grab!!!"
Angel Micheal: "Na true boss.. chai boss you too sabi"
God: "I too sabi na.. Oya pour am water of stubbornness"
Angel Micheal: "We no need pour plenty na... Make she no cause plenty Wahala"
God: "You this boy, book you no sabi.. the only thing you sabi na to dey fight up and down for this heaven.
If she no cause plenty Wahala, how son of Adam go take get prayer point wey I'm go dey pray give me.
My friend carry this woman go put for inside Red Sea make stubbornness water enter her body well well.
Na why Jesus na only begotten Son. Because you no get sense.
Shei you grab!!!
Your virgin sharwama husband!!!
It's a joke ooo... Cos I know you guys.