22/03/2025
Nnamdi Kanu don plead not guilty to terrorism charges wey Nigeria goment sama am as im trial begin afresh on Friday.
Di trial of di Indigenous People of Biafra (Ipob) start afresh for di Federal High Court in Abuja, afta Kanu ask Justice Binta Nyako to withdraw hersef from di matter wen e accuse her of partiality.
At di resumed hearing, Kanu plead not guilty to di seven counts of terrorism against am.
Justice Omotosho wey dey in charge of dis case now, grant accelerated hearing for di matter as e don drag on for 10 years come adjourn di case to to 29 April, 2nd and 6th May 2025 for trial to start.
Nigeria goment dey accuse Kanu of terrorism and attempts to bring down goment, sake of di activities of Ipob, a group wey dey agitate to break away from di south eastern region of Nigeria to become independent kontri wey im name go be Biafra.
Also earlier for court on Friday, Kanu Agabi, a former Attorney General of di federation wey be one of Nnamdi Kanu lawyers wen di matter bin go to di Supreme Court bin don apologise for Kanu outburst against di former judge for di case, Binta Nyako.
Kanu case dey start again becos wen a new judge take over a case wey bin din dey go on, e no matter how far di case bin don go, di matter go start again from di beginning.
More on di tori dey here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4g0j55pk1qo